Watch Sex Slavery in Europe Inside dis video, seven naija women wen escape ashawo work for Italy explain di horror why dem meet when dem reach Europe. Before dem comot for naija dem tell dem say dem go get decent job as cleaner, or as sales girls for shop, or even as house geh. But di madam wen cari dem reach Europe force dem enta ashawo work. Anytime wen dem refuse dem beat dem and threaten dem say den go die becuz before dem comot for Naija, dem been don take oath say dem no go run from any job wen dem give dem for Europe.
Watch A Journey Through Hell Inside dis video seven Naija women wen escape ashawo work for Italy explain di horror of di joni from Naija tru Niger and Libya. Dem abuse dem, rape dem, den even sell dem give men for inside brothel.
Watch Still Living di Nightmare Inide dis video, nine Naija women talk about deir experience afta dem don traffic dem from Naija go Europe go do ashawo. Dem describe how di experience affet dem mentally. Now, den don run from di pipo wen dey torment dem, but den still dey suffer from depression, bad memory and bad dream.
Watch Rita's Story: Thrown to the Wolves Rita been dey live for street for naija and she dey survive as a beggar for on a daily. One day nai one friendly woman approach am cari an go house. She tell Rita say she get supermarke for Europe and ask if Rita go like travel go work for dere. Rita belle sweet.
Watch Nora's Story: On the Streets of Europe “Dat place na dere we dey sleep but we dey go dey hustle for street. In di night, in di morning, in di afternoon, we dey road. Many many girls wen don die for road work for Italy wen be say den don kill”. Nora travu go Europe becos for her mind she been think say she go find work wen go allow her to support her family for Naija, but she end up as ashawo for street. Watch her story!
Watch Janet’s Story: Forced into ashawo through Voodoo "E still cari me go another place where dem collet my pant, den con collect hair for my armpit, even for my private part. Dem say if I run comot dem go use di hair do something wen be say I go fit dey mad". Dem promise Janet job for South Africa but she end up inside ashawo work for Europe. Watch her story!
Watch Florence’s Story: Fled rape but fed lies of a better life abroad “She say weda me no know say na dis prostitution work nai me wan con do for Europe. Nai I say me I no go fit do dis ashawo work". Dem promise Florence beta work for Europe but las las na ashawo work dem cari her go do. Na so so lie nai madams dey lie give women all in the name of beta work for Europe, beware!
Watch Judith’s Story: Haunted by Madams' Juju “Den con say make I swear say if i cari di woman moni run, say I reach dere I con dey see work or say di woman go come put me for work, say make dis tin kill me". When Judith reach Italy she find out say di job wen dey arrange for her na ashawo work. Madams dey try to trick young women with juju. Spread di message!