– LILIANShe say dat one wey she tell us for Nigeria say dat one na lie. Say na ashawo we wan con do. Ashawo? Ashawo wen me no do for Nigeria before I comot, na abroad I wan con do am? She say if me no do am, me go die, say shey me forget say me swear oath?
– PATIENCEAs we come for Italy, nai she con say we go con dey do dat job. So, some of us even injure. Injury dey but den no care.
Di madams dey hard and dem wicked. Dem force di women go street go do ashawo everyday. Den collect all di money way dem make and anytime wen dem no bring enuf money come house, dem go beat dem and pursue dem go outside.
– LILIANSometimes I go work 200 euro a day, I go give her. She go still dey beat me dey curse me say dat one no do. She go dey pursue me go road.
– MERCYDi woman dey maltreat me. Maybe if I no work come e go dey insult me, dey tok.
– TINAE get di day wen I no fit bring moni, because di cold, di sufa, everytin too much.
All of dem manage to escape deir madam and now dem dey warn young women like dem about wetin go happen to dem if dem sef go believe di sweet promise say any madam fit give dem beta job for Europe.
– NORAI know di way wey Nigeria be, everyday nai den dey smuggle pipo dey come Europe. So experience wen I pass through, I no want make anybody... even my blood or another woman like me to experience that kind tin".