“I said, Yes, why not. I want to travel. She said okay she want to take me to Europe. I said okay wow. She said when I reach dere, many tins, many work, supermarket... I will sell for supermarket for her"
Before dem comot for naija, she tell Rita say she go gas take oath to make sure say she go pay back the moni wey dem go take cari her travu. Di woman tell her say di moni wey she go pay na 35,000 and Rita say okay. Rita been think say na 35,000 naira, but she no know say na Euro.
Di woman folo rita enta di joni through Libya. Her behaviour con change for road. As men dey abuse, rape and beat Rita for road, the woman no put mouth, she no send at all.
Di joni from naija to Libya take one month, na very very bad experience. Rita see as people just dey die. When she cross di sea reach Italy, den con carry her comot for reception centre go Florence, for Florence Rita been dey think say she go start di job wen dem promise her, but instead she see herself for ashawo house where dem tell am say she gas work to pay back di money wen den claim say she owe. Afta three month of locking Rita for inside house, she manage to escape and run go Germany. Now Rita dey Germany dey apply for asylum but she still neva get leave of mind. The madam for Italy still dey threaten her upandan.